Da Trybe, Eldee and 2Shotz - Carry Am Go

Trybe Records
2Shotz
Trybe Productions
Eldee The Don

When I dey primary five ehen
I get one friend
E no dey too dey class e no just send
You see Emeka no know book but for class
Everybody dey wonder how him take dey pass ole
One day we get lecture wey Emeka dey dere
Him just dey concentrate like say him mind dey there
For where na gimmicks make we take no fear
The boy just dey strategize some skills and ideas
You don see two eyes dey offload your hand bag
Wey person pass you con dey find your school bag
Dey follow you dey argue on top am dey brag
Ah ah na your own no get label for the tag
Shut up my friend how you take know
If I finish with you na your blood go dey flow
Bros abeg now abeg no be so
In fact when I take the bag I no know

Thief my guy bag talk say him no know
Thief ole carry am go
E say na him first time abi no be so
Thief ole carry am go
When you hear bring tire your eye come clear
Thief ole carry am go
Carry gun carry knife only you no dey fear
Thief ole carry am go

See this man self see as you kack for office
You dey form oga while your people them dey hiss
Na pen you dey take do magical tricks
You no dey touch money but money go dey miss
Your five account them don full for swiss
You dey chop and you think say them no go notice
Wetin you dey do bad and you know this
You say I'm smart and you are a novice
Na true you talk but na thief be your work
When your hear bring tire make you no shock
Your job na with tie and corporate knocks
Agbada or kaftan aso and rocks
Na this one we dey call thief with style
Chop alone and close the file
Everyday empty promises go dey pile
It is not my fault my brother but mean while

Embezzle money talk say him no know
Thief ole carry am go
You say na your first time abi no be so
Thief ole carry am go
When you hear bring tire your eye come clear
Thief ole carry am go
Carry pen carry pidgin only you no dey fear
Thief ole carry am go

Your song never comot but e don dey Alaba
As you sing finish them go carry am waka
E go con plenty like cloth for Yaba
E don dey go platinum but my pocket is flatter
Na my own sweat them dey use make dough
See these MCs thief my flow
Put my life savings con carry am go
Bring tire fuel matches oh no

Pirate my CD talk say him no know
Thief ole carry am go
You say na your first time abi no be so
Thief ole carry am go
When you hear bring tire, your eye come clear
Thief ole carry am go
Ten thousand copies only you no dey fear
Thief ole carry am go

Carry am go
Thief ole
Carry am go ole
Carry am go
Thief ole
Carry am go ole
Bring tire
Carry am go
Thief ole
Carry am go
Ten thousand copies only you no dey fear
Thief ole
Carry am go ole

Ajibole
Ole
Ajibole
Ole
Onye oshi
Ajibole
Ole
Onye oshi
Ajibole
Ole
Onye oshi
Ajibole
Onye oshi
Ole
Onye oshi
Ajibole
Onye oshi
Ole
Onye oshi
Ajibole
Onye oshi
Ole
Onye oshi
Ajibole
Let's dance

Written by:

Publisher:
Lyrics © TUNECORE INC, TuneCore Inc.

Lyrics powered by Lyric Find

Da Trybe, Eldee and 2Shotz

View Profile
The Big Picture (Deluxe Edition) The Big Picture (Deluxe Edition)