Brisco Oyiodudu - God Engineering (Intro)

It's God Engineering
Oyiodudu Ke Wo Dudu
Achikoje
Baba see i don come today i want make you bless me
See as i dey you know say poverty no fit me
Na why i dey work make dem no go see me finish
Baba na you create me and you know wetin go suit me
Gucci and Gabana for my leg e no go bad na
Designer clothes and gold chane e no go sad na
The street be like game baba give me control pad na
Make i the control things e don tey i the call them boss na
Baba you dey for up there and i know say you the look me
Instead wey i go poor for this life e better make you shoot me
When i go go big shows wey them go start the book me
Everytime i ask my self baba make you help me
But baba no the vex e be like i don too disturb you
The street no get joy na why boys the involve you
But bad as e be anyhow me i go still love you
Na truth i the tell you no be say i don the job you
As we the work everyday wey we the try to the meet up o
Baba ooo oh
Make you reason the matter make you start to the help us o
As we the work everyday wey we the try to the meet up o
Baba ooo oh
Make you reason the matter make you start to the help us o
(Sha)
But as we don wake up today na by your grace no be power
And since we don the breath we go still dey on top the matter
And the quest to the fame make them the hear our name
Beacause pikin wey no dey patience e get nothing to gain
Confession time reverend tell my father say na me
And i don come hear with full force today to confess all my sins
I know say i don do bad things wey don the block my progress
Lord forgive me my sins make i secure the success
Life no be joke no be say you happy as i broke
I just want pray for better days make i fit the cope
This na prayer for the street as i don come i get hope
Make you reason am for me make you shower me some dor
Oluwa see me i don come and me i still kneel down for here
I no go comot for this place till i see your blessings for here
And as you don the elevate me no go let me fall
Money fit me die abeg abeg no go let me fall
As we the work everyday wey we the try to the meet up o
Baba ooo oh
Make you reason the matter make you start to the help us o
As we the work everyday wey we the try to the meet up o
Baba ooo oh
Make you reason the matter make you start to the help us o

Written by:
Nick Abah

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Brisco Oyiodudu

View Profile
God Engineering - EP God Engineering - EP